what is your favourite nigerian proverb and what does it mean to you!!!!!

Date: 31-07-2009 7:04 pm (14 years ago) | Author: Nosa
[1] 2 3 4 ... 22
- at 31-07-2009 07:04 PM (14 years ago)
(m)
theres been an obvious decrease in the everyday use of Nigerian proverds, these days...the youths of Nigeria only believe its for the old ones or only used in Igbo and Yoruba movies.......but lets all come together and put forth that particular proverd you have always had in your heart.....maybe i should start first, abi now!! Grin Grin

Posted: at 31-07-2009 07:04 PM (14 years ago) | Gistmaniac
- enjoyment at 31-07-2009 07:08 PM (14 years ago)
(m)
proverd abi na watin u call am start now am waiting.....

Posted: at 31-07-2009 07:08 PM (14 years ago) | Gistmaniac
Reply
- portiphar at 31-07-2009 07:22 PM (14 years ago)
(m)
pikin wey say him mama no go sleep, him sef no fit rest lai lai
Posted: at 31-07-2009 07:22 PM (14 years ago) | Gistmaniac
Reply
- enjoyment at 31-07-2009 07:32 PM (14 years ago)
(m)
na na wrong 1....pikin wey say him mama no go sleep na orphanage home dem go carry am go....

Posted: at 31-07-2009 07:32 PM (14 years ago) | Gistmaniac
Reply
- portiphar at 31-07-2009 07:37 PM (14 years ago)
(m)
the masquerade wey dance first for festival, na him go first tire, meaning the first person to start something gets tired first always
Posted: at 31-07-2009 07:37 PM (14 years ago) | Gistmaniac
Reply
- portiphar at 31-07-2009 07:39 PM (14 years ago)
(m)
cow wey no get tail, na God dey help am pursue fly
Posted: at 31-07-2009 07:39 PM (14 years ago) | Gistmaniac
Reply
- portiphar at 31-07-2009 07:49 PM (14 years ago)
(m)
pikin wey say him papa soup no sweet, him don ready to find how wetin pursue him mama for house
Posted: at 31-07-2009 07:49 PM (14 years ago) | Gistmaniac
Reply
- enjoyment at 31-07-2009 09:26 PM (14 years ago)
(m)
Quote from: portiphar on 31-07-2009 07:37 PM
the masquerade wey dance first for festival, na him go first tire, meaning the first person to start something gets tired first always

anoder mistake d 1 wen first dance na him go collect all the money b4 others show face...

Posted: at 31-07-2009 09:26 PM (14 years ago) | Gistmaniac
Reply
- enjoyment at 31-07-2009 09:27 PM (14 years ago)
(m)
Quote from: portiphar on 31-07-2009 07:39 PM
cow wey no get tail, na God dey help am pursue fly

Cow wey no get tail i neva see am b4 and if e dey na fly go chop all e yansh b4 e die

Posted: at 31-07-2009 09:27 PM (14 years ago) | Gistmaniac
Reply
- enjoyment at 31-07-2009 09:32 PM (14 years ago)
(m)
Quote from: portiphar on 31-07-2009 07:49 PM
pikin wey say him papa soup no sweet, him don ready to find how wetin pursue him mama for house

dat mean say d papa na useless papa to have pursue the mama commot 4 house....

Posted: at 31-07-2009 09:32 PM (14 years ago) | Gistmaniac
Reply
- portiphar at 31-07-2009 10:57 PM (14 years ago)
(m)
enjoyment, oya talk your own favourite Nigerian proverd na, i dey wait for you jare!
Posted: at 31-07-2009 10:57 PM (14 years ago) | Gistmaniac
Reply
- portiphar at 1-08-2009 10:28 PM (14 years ago)
(m)
besides, Alagemo (the masquerade) done born pikin, e dey up to the child to decide whether him wan dance or not!
Posted: at 1-08-2009 10:28 PM (14 years ago) | Gistmaniac
Reply
- enjoyment at 1-08-2009 10:29 PM (14 years ago)
(m)
even alagemo dis days no dey dance again ....are u aware?

Posted: at 1-08-2009 10:29 PM (14 years ago) | Gistmaniac
Reply
- enjoyment at 1-08-2009 10:30 PM (14 years ago)
(m)
na useless pikin na im dey use left hand dey point him papa house.......

Posted: at 1-08-2009 10:30 PM (14 years ago) | Gistmaniac
Reply
- portiphar at 1-08-2009 10:49 PM (14 years ago)
(m)
what if sharia law don cut him right hand
Posted: at 1-08-2009 10:49 PM (14 years ago) | Gistmaniac
Reply
- portiphar at 1-08-2009 10:53 PM (14 years ago)
(m)
and frog no dey waka for daytime, na either e dey pursue something or something dey pursue am
Posted: at 1-08-2009 10:53 PM (14 years ago) | Gistmaniac
Reply
- portiphar at 1-08-2009 10:55 PM (14 years ago)
(m)
wetin small pikin dey dey stretch neck to see, old man go see am from where him siddon
Posted: at 1-08-2009 10:55 PM (14 years ago) | Gistmaniac
Reply
- portiphar at 1-08-2009 11:12 PM (14 years ago)
(m)
the spider wey say make elephant no go river, na him and the elephant go reach there together
Posted: at 1-08-2009 11:12 PM (14 years ago) | Gistmaniac
Reply
- enjoyment at 1-08-2009 11:39 PM (14 years ago)
(m)
Quote from: portiphar on  1-08-2009 10:49 PM
what if sharia law don cut him right hand
himgo use  right elbow point am....lol

Posted: at 1-08-2009 11:39 PM (14 years ago) | Gistmaniac
Reply
- portiphar at 2-08-2009 12:01 AM (14 years ago)
(m)
lailai
Posted: at 2-08-2009 12:01 AM (14 years ago) | Gistmaniac
Reply
[1] 2 3 4 ... 22