Logo Buy Naijapals merchandise (cloths, bags, mugs, clocks est.)

Home   |    Help   |    Advanced search

Top 10 reasons not to marry an "AKATA" (joke)

 
ForumEntertainmentFunnyHub (Jokes, funny pictures & videos e.t.c)Topic: Top 10 reasons not to marry an "AKATA" (joke)

ReplySend this topicPrint




Pages: [1] 2 3

Author Topic: Top 10 reasons not to marry an "AKATA" (joke)  (Read 892 times)
vixenx
vixenx
(see profile)
Female
Offline Offline
Posts: 20900
Addicted Hero
« posted : September 29, 2007, 05:25:02 PM »
Reply with quote

These are the top ten reasons why man no fit carry Akata put for house:

10. If una joke with naija woman sey you wan marry second wife put for house because you get complaint sey her okro no dey slide again, she go wave you off becos she know sey dat na joke,..but if you tell akata dat one, she go use dat one sentence wey man dey hate:'Where you think you at, Africa?'

9. If you carry ya wife go Naija, and mosquito bite am, if na naija, she go know sey na 'Welcome Home' sign be dat, but Akata go tell you say: 'Maaaaaan, this is Bulls**t!'

8. When una dey for naija, village people no go wan hear the difference sey na Akata , the only thing dem go dey talk about for the next six months be say you carry wife come and the wife dey extend hand wan shake ya granpapa instead of make she kneel down! (No room for error in that department!)

7. If you get argument with naija woman and she vex for you, the most she fit threaten you with na sey:'I GO PACK COMMOT FOR HERE GO MY PAPA HOUSE!', but if na Akata threaten you, she go say "YOU'LL BE ON THE BOAT BACK QUICKER THAN I CAN _b_link__!'....eyin people, dat no be joking mata O!

6. Unlike Akata, Naija woman go understand sey if we troway party and people come dey spray money, dat no mean wey we go do am every month for extra income!

5. If I marry Akata and we come born pikin, yawa go bust if she wan gi my pikin name wey no get meaning like Tyrone, G-money,or Shakwanna Or Besides, she sef fit get problem with names like Kolawole,Gbolahan, Omokorede or Efunsetan...If I win the name battle sef, she fit because she not sabi pronounce pikin name dey call am 'Yo!'

4. If you vex naija woman , get SERIOUS 'argumentation', and then you come turn around ask am for favor, if she no go do am, the most she go do na to do im eyelids up and down like sey you dey pull electric switch 'ON' and 'OFF' 7 times,roll im eyes, hiss the kin hiss wey go last like 20 seconds , make U-turn waka comot!.., but if na Akata, the only thing you go hear na:'KISS MY BLACK **S!'

3. If you get pikin and you wan feed am Amala (ancestral delicacy, yummy!) with egusi or okro soup, the only thing naija woman go tell you be say make you make sure say E no dey too hot,....but Akata go look in amazement as the elubo turn from White to Black, and any attempt to feed the pikin dat go receive: 'I KNOW you sure ain't trying to feed him THAT s**t!'...(I tell you, man no wan make na soso barbeque chicken pikin go dey chop O!)

2. I don't want to risk being with someone who's gonna be trying to crack 'mama jokes' while my folks are within 5 yards of an earshot......'Hey, Pa, yo mama's so...OUCH!'

and , the number one reason......is.....

Hey fellas, I 'm sure say una don go bar (some call it the strip joint) wey Akata go dey dance dey shake yansh (we call it 'The Bounce') and she go think sey she dey do sontin,..but I tell you, dem need to come serious naija 'Alagbada' come see how to shake yansh! I swear, I don see naija babes (bota or no bota) gbon dat IDI and the speed was in the neighborhood of 8000 rpms!

Now, how man go see that kin heritage come go carry Akata for house? Akata koo, Okete nii!
Logged

Drugs are bad; however, i've been FDA approved!!
stifler
stifler
(see profile)
Male
Offline Offline
Posts: 35
Newbie
« posted : June 02, 2008, 11:15:38 AM »
Reply with quote

watin 1 make i marry akata when nija ladies are still beauty till 70
Logged
youngholla
youngholla
(see profile)
Male
Offline Offline
Posts: 13
Newbie
« posted : June 03, 2008, 06:09:04 PM »
Reply with quote

watin 1 make i marry akata when nija ladies are still beauty till 70

End of thread.

Logged
Nautillus
Nautillus
(see profile)
Male
Offline Offline
Posts: 134
Upcoming
« posted : June 04, 2008, 01:07:01 PM »
Reply with quote

LOL so so true
Logged
dhayor
dhayor
(see profile)
Male
Offline Offline
Posts: 24
Newbie
« posted : June 04, 2008, 03:40:44 PM »
Reply with quote

Me,Myself & I,i no fit think am sey make i marry akata for house for one "iseju" and besides no be go dey chop food wey dem package inside "agolo".lol  Smiley Wink Grin


* me.jpg (2.22 KB, 88x88 - viewed 158 times.)
Logged
meczytimber
meczytimber
(see profile)
Male
Online Online
Posts: 336
Upcoming
« posted : June 04, 2008, 07:17:40 PM »
Reply with quote

i no fit marry akata o. anyway, it was fun, i laff tire
Logged
Sexyasakenke
Sexyasakenke
(see profile)
Female
Offline Offline
Posts: 778
Upcoming
« posted : June 04, 2008, 11:38:36 PM »
Reply with quote

roflmao..........................
Logged
khadijah
khadijah
(see profile)
Female
Offline Offline
Posts: 2998
Naijapals Addict
« posted : June 07, 2008, 03:06:28 AM »
Reply with quote

akatas get their good side too o.`
Logged
danny7
danny7
(see profile)
Male
Offline Offline
Posts: 172
Upcoming
« posted : June 10, 2008, 01:28:51 AM »
Reply with quote

though i don't undertand your writing i'll tell you one reason to marry akata(or watever ya cal it)they are EXTREMLY HOT!!!!
Logged
zoaka
zoaka
(see profile)
Female
Offline Offline
Posts: 7
Newbie
« posted : June 13, 2008, 09:56:48 AM »
Reply with quote

no place like home no woman like nij  woman she can be fix in any way u went her to be up or down any where
Logged
lucychizzy
lucychizzy
(see profile)
Female
Offline Offline
Posts: 1208
Naijapals Addict
« posted : June 19, 2008, 02:24:28 PM »
Reply with quote

na who say naija babes no hot?
i am hottest
Logged
Abby
Abby
(see profile)
Female
Offline Offline
Posts: 177
Upcoming
« posted : June 21, 2008, 12:25:09 AM »
Reply with quote

na who say naija babes no hot?
i am hottest
lol, abeg tell am
Logged
Assadiq
Assadiq
(see profile)
Male
Offline Offline
Posts: 1
Newbie
« posted : July 31, 2008, 01:30:40 PM »
Reply with quote

HOTTEST Na wa for naija women i no no say we hv hottest like AKATA Wink
Logged
ecstasy700
ecstasy700
(see profile)
Male
Offline Offline
Posts: 14
Newbie
« posted : August 09, 2008, 04:02:10 PM »
Reply with quote

THE IS QUITE OKAY, BUY BELIEVE ME .....I KNOW GO FIT MARRY AKATA.....IF I MARRY AKATA, I GO FIT CONTROL HER SINCE NA ME BE THE HEAD OF THE FAMILY......NA NO DULLING GAME....YOU DONT DULL YOURSELF FOR ONE AKATA......
Logged
monalisa
monalisa
(see profile)
Female
Offline Offline
Posts: 9
Newbie
« posted : August 15, 2008, 05:23:19 PM »
Reply with quote

vixenz, o girl abeg u no fit kill me. ah no be small ooooooooo as 4 me i no fit nod yes for head, con talk of to pronounce am fully say yes. lie lie eh no work.
Logged

Pages: [1] 2 3   Go Up


ReplySend this topicPrint
ForumEntertainmentFunnyHub (Jokes, funny pictures & videos e.t.c)Topic: Top 10 reasons not to marry an "AKATA" (joke)
Jump to:  
+ Quick Reply
With a Quick-Reply you can use bulletin board code and smileys as you would in a normal post, but much more conveniently.


Home  - Invite friends  - Badges  -  Forum  -  Companion  - Music  - Videos  - Confessions  - Blackboard  - Privacy  - Terms  - Feedback  - Help

Naijapals Network ©2007-2008.